Wawa man tori

Wawa man tori

A Poem by BAMBE ABASS ABIDEMI
"

Una life dey at risk

"
Burukutu no be your mate
But you dey take am late
Tai-tai na something una pipu
Don vex ignore like smelling pupu
The way you dey hustle for pami
For any occasion don make your mami
Regret to dey pray for you
All the bill wey don overdue
Na you carry the money buy Colorado
The way you dey chop pawpaw sef mado
Na everytime dem dey find tram and tutolin
For your bag, but shey no be dem kill slim Selin
When the tori reach your side, una say
No be tablet but na de curse where she chop and no wan pay
Her tori no fear you, na ginger he be for you
I hear say your mami no fit pay for your CS
And area boys no dey leave your side for a secs
Abi who go inherit the Colo wey dey your bag?
Two days before you kpeme forget your swag
Your mami see shege for some b*****d
As you dey call dem, dem dry your house hard
Tori reach your side you no understand shishi
Na so life be, your area boys don commot with wee-wee
Na evening dem arrange you come area
Everywhere good but mami no gree give her prayer.

© 2023 BAMBE ABASS ABIDEMI


My Review

Would you like to review this Poem?
Login | Register




Share This
Email
Facebook
Twitter
Request Read Request
Add to Library My Library
Subscribe Subscribe


Stats

39 Views
Added on July 20, 2023
Last Updated on July 20, 2023

Author

BAMBE ABASS ABIDEMI
BAMBE ABASS ABIDEMI

Ibadan, west, Nigeria



About
I am Abass Abidemi Bambe. I write poems, jokes,essays, articles and short stories and other fictional works. I love to pen down sad literature that picture the sorrows going on in the world or those .. more..

Writing